Like play, like play, dis your sweetheart don turn big 4 months old pikin and na dis stage of him young life na im dey sweet pass. Now, he go don dey more expressive. He go dey smile, laff, make baby talk join sef.
As new mama, you sef go don dey see new changes for him body.
By dis time, your pikin go don round well well. Even him cheeks go don come full. You sef go don dey prepare yourself emotionally because d happiness wen he go give you go make tears drop.
You fit dey ask yourself wetin go come happen. Na some of d few things wen go go notice sey different for your pikin dis month be dis.!
4 Months old development: Shey your pikin dey on track so?

Physical development for your 4 months old pikin
For dis 4 months wen your pikin dey so, di way wen your pikin go take grow, go fast pass as you don see before now. Even him weight go don add put.
By now, your pikin median length and weight* suppose be:
- Boys
– Length: 64.0 cm (25.2 inches)
– Weight: 7.0 kg (15.4 lb)
- Girls
– Length: 62.2 cm (24.5 inches)
– Weight: 6.6 kg (14.6 lb)
And him head suppose be:
- Boys: 41.6 cm (16.4 inches)
- Girls: 40.6 cm (16.0 inches)
You go don notice sey your pikin don sabi raise him head without any support. You go even see sey if your pikin na d active kind, anytime your pikin dey hard surface, he go try to dey push him leg down.
Since dis month, he don dey learn how e go dey move, you sef go don prepare your phone down wen you wan use take dey video am. Now, you go see sey he don dey put him hand for mouth, he go don even dey push him elbow up wen he lie down for him belle.
For dis stage wen he dey so, anything wen your pikin carry must enta him mouth. So any toy wen you buy wen dey shake or on light go las las still enta him mouth. If na your hair he grab, he go still put am for mouth.
Your pikin fit don dey roll by now. Some 4 months old pikin don even get their first tooth by now.
For dis kind time, your pikin eye go don dey move together. He go don sabi focus well wen he see any thing wen move or wen he see any bright thing. Dis na because him sight go don reach 20/40. He go don sabi different colour. So if your pikin still never fit move him two eye by now, go see your doktor.
Tips
- Anytime wen you hold your pikin, make sure sey you commot any thing wen you wear because he fit drag am put inside him mouth.
- He fit don sabi as e go turn on top him belle by now, but if he still neva sabi, make you still dey give am tummy time.
- If you get money, buy baby gym for your pikin. With your help, he go wan stand or siddon but he no go fit do am tey make he for no go get bow leg.
- Make you buy bok and toy wen your pikin fit dey use take learn. As time dey go, he fit drop all dos one, carry spoon, allow am carry wooden spoon instead. Dey careful make he no go carry wetin small he fit put am for mouth swallow.
- Once your pikin don sabi to move round d house, commot everything wen fit break from where him hand go fit reach, lock all your cabinet dem, make no wire dey ground.
When you fit see doktor
If your pikin:
- Just no get interest for anytin wen he been dey use take play.
- Hear your voice and he no react.
- No dey wave him hand.
- Get issue wen he wan turn him head.

Cognitive Development of 4 months old pikin
While you dey notice all dese physical changes wen dey happen, you go dey surprise to notice d way him cognitive development take fast dis month.
Your 4 months old pikin go dey respond to d affection wen you dey give am pass before. Wen you call him name, he go look you smile.
The coordination of him hand and eye go don realli improve by now. So, once he just see anytin, he go don stretch him hand take collect am. As him moto skills don develop, you see sey once he see something, he eye go follow dat thing.
Tips
- Follow your 4 months old pikn play peek-a-boo.
- Engage your pikin sense as you fit. Call am from different corner of d room.
- Read book wen get shape and colour give am.
- Use him stroller take am go outside. No make am watch plenti television.
When you fit see doktor
If your pikin:
- No dey follow you and oda pipu smile.
- Dey find am hard to grab him toy dem.
Social and emotional development
As far as your pikin emotional and social growth dey concerned, you go dey happy to see new development dis month. Since your pikin don old reach to dey respond to emotion, you go see sey he go dey smile pass before.
But d ability to take respond to your own emotion dey get him own amount of cry o.
If you like to follow your pikin play and you come stop, e fit make am cry. For dis him age, he go like play and he fit tell you weda he wan stop or continue.
Once you make funny face give your pikin, no fear sey he go wan do d same thing. Children wen dey dis age dey sabi copy wetin dem see.
After all, na from him mama he get am!
Tips
- Dis your sweet pikin go start to do things make he for see as you go take react. He fit pull your hair or bite your breast wen he dey feed. If you tell am "no" for voice wen gentle, e dey enuf to show sey you no dey happy with wetin he do.
- Graduate from books wen get black and white to d ones wen get colour.
- Follow your 4 months old pikin dey read/sing, make you dey interact with am.
Wen you fit see doktor
If your pikin:
- No just show any reaction to face wen new.(happy/ sad/ anxious)

Speech and Language Development
As your pikin don turn four months old, d way wen he dey take express himself go don rise. Now he go fit tell you weda he dey sad or happy. No be with word o, na with him smile/cry.
As you dey try undastand how your pikin fit behave, no forget sey na from you he dey pick everything wen he go sabi.
So once you call your pikin sweet name, just know sey he go wan copy d thing wen he hear. Even if he no get am correct.
Tips
- For you to fit encourage your pikin language skill, follow am talk like sey na adult you dey follow talk.
- Use complete sentence and correct english for am. No forget to use " Please" and "Thank you". Even if your angel sabi wetin you talk, he go still fit undastand wen he don big pass so.
When you fit see doktor
If your pikin:
- No just dey make any noise at all.
Health and Nutrition
By now, your pikin go don dey weigh 6.2 to 7.8 kgs. Him height/ length go dey between 58 to 66 cms. E dey different with pikin.
For food matter, your pikin still need breast milk wen dey adapt as d month dey go to take suit your pikin nutrition.
By dis fourth month, e go don get better schedule wen he dey use take sleep. Normally, pikin dey sleep for 7-8 hours wen he don reach dis age. By d time you add one or two naps, you go see say he go don sleep minimum 12-13 hours every day.
At this age, your baby go receive him second dose of 5 in 1, him second dose of Rotavirus vaccine, and him first dose of PCV.
Tips
- Breastfeed your pikin as you dey do before. Ask your doktor if he need Vitamin D supplement.
- No allow anybody wen dey help you take care of your pikin give am anything wen solid yet.
- Ask your pikin doktor make he give am injection against cold.
- Commot anything wen dey your pikin bed as dem fit choke am wen he dey sleep. No forget make you always dey put your pikin for him back wen he wan sleep.
When you fit see your doktor
If your pikin:
- No dey grow by d correct measurement wen be percentile.
- Dey run temperature wen be 38 degrees Celsius or higher.
- Get rashes, bruise or use him head take hit sometin.
- Dey vomit everytime.
Source: Web MD
Previous month: Baby development and milestones: Pikin wen be 3 months old
Next month: Baby development and milestones: Pikin wen be 5 months old
Republished with permission from theAsianparent
*Disclaimer: This is the median length and weight, and head circumference according to WHO standards)