We know sey Naija na de most populous country for Africa. For inside de thirty-six states for Naija and including FCT, more dan three hundred cultural group tanda gidigba for there. For these three hundred cultural group plenty names dey to choose for your pikin.

For mama wey dey expect beautiful baby wey go soon join dem family, name wey you go give de pikin fit dey trouble you for mind. De name wey you give your pikin fit make am easy to identify where de pikin come from. If you dey reason to give your pikin your village name, you no need to rack your brain for wetin you go choose. We don collect 50 popular Naija baby names and dem meaning. You fit choose your pikin name from de list.
Wetin be de 50 Popular Naija Baby Name Wey you Fit Choose from
Name |
Meaning |
For which gender |
Anuoluwapo |
Mercy of God plenty |
Male and female |
Abidemi |
Born before papa arrive |
Male and female |
Abimbola |
Born inside wealth |
Male and female |
Abiodun |
Pikin wey dem born during festive period |
Male and female |
Abiola |
Born inside wealth |
Male and female |
Adaego |
First daughter wey bring wealth |
Female |
Adaeze |
De king first daughter |
Female |
Adaku |
Girl pikin wey dem born inside wealth |
Female |
Adaobi |
De first daughter for de family |
Female |
Adesuwa |
Inside prosperity |
Female |
Adewale |
Crown come home |
Male |
Adeyemi |
Crown fit me |
Male and female |
Affiong |
Born for one of dem traditional week day |
Female |
Aisha |
Alive and well |
Female |
Aminu |
Trustworthy |
Male |
Babatunde |
Papa don return |
Male |
Bankole |
Helep me build house |
Male |
Bimpe |
Gorgeous |
Female |
Bolanle |
Meet wealth for house |
Male and female |
Chibuzo |
God lead way |
Male and female |
Chika |
God dey great |
Male and female |
Chinyere |
God give |
Female |
Chioma |
Good luck |
Female |
Chukwudi |
God dey |
Male |
Chukwuemeka |
God don do something great |
Male |
Damilola |
Bless with wealth |
Male and female |
Danjuma |
Born on Friday |
Male |
Edosa |
God dey |
Male and female |
Efe |
Wealth |
Male |
Efosa |
God wealth |
Male |
Ekaete |
Named to honour papa’s grandma |
Female |
Eniola |
Wealthy person |
Male and female |
Faruq |
Person wey fit detect truth from lie |
Male |
Habibah |
Beloved |
Female |
Halimah |
Healthy |
Female |
Idemudia |
I come standing |
Male |
Ifeoma |
De beautiful one |
Female |
Ikechukwu |
God’s power |
Male |
Imaobong |
God love |
Female |
Iniobong |
God time |
Female |
Itoro |
Praise |
Female |
Latifah |
Gentle and kind |
Female |
Modupe |
I give thanks |
Female |
Nnamdi |
My papa dey alive |
Male |
Okafor |
Born on afor day |
Male |
Olabisi |
My wealth increase |
Male and female |
Osaze |
Na God dey choose |
Male |
Titilayo |
Joy na forever |
Female |
Yetunde |
Mama don return |
Female |
Zahrah |
Flower |
Female |
Shey You Like The Name Dem?

Dese na de names wey you fit choose from. De names cut across major ethnic groups wey dey Naija. Whether you be Hausa, Yoruba, Igbo, Edo or Ibibio, you go find name wey you fit give your pikin from de list of 50 most popular Naija baby names. Some of de names fit go with male or female pikin while some dey unique to de gender of your pikin. As you dey welcome de new pikin to de family, make sure sey you find am lovely name.
Read this tori join: Boy And Girl Baby Names That Carry Good Fortune
https://www.shutterstock.com/image-photo/young-black-nigerian-mother-her-newborn-182724017
https://www.shutterstock.com/image-photo/young-black-nigerian-family-newborn-baby-182723996