Africaparent Logo
Africaparent Logo
EnglishSwahili
  • COVID-19
  • Becoming a Mama
  • Ages & Stages
  • Parenting
  • Health
  • Feeding & Nutrition

Some Common Fights Wey Dey Happen For Early Years Of Marriage

4 min read
Some Common Fights Wey Dey Happen For Early Years Of MarriageSome Common Fights Wey Dey Happen For Early Years Of Marriage

E get some kain fights wey dey happen for early years of marriage. Know wetin dem be so you go dey ready wen e hapun.

Many of dem changes wey dey arise wen two people come together fit create yamayama, from family dynamics to finances. Dis dey lead to some common fights wey many couples get for de early years of dem marriage.

Nearly every married people dem dey enta marriage with tought sey dem go be great spouse. But once dem don say de vow, reality go begin show face — marriage nor just dey as easy as we bin dey reason am. With de combining of family, friendships, belongings and money, challenges and problems go boku. American relationship therapists believe sey na dese be dem common fight wey many couples for de first year of marriage. Dem also share how to take navigate all dese dem complicated issues.

Check Out Some Of De Common Fights Wey Couples Dey Get

Fight on top moni

common fight for moni

Moni  na very popular tricky subject for couples — especially dem wey just marry and wey just start to dey combine finances, begin dey shop for dem first home dem dey reason about how to take start family. Wen una still dey date or even if una don dey live together, e fit dey easy to hide your finances. Once una don marry like dis, most partners learn de truth about tins like de true amount of debt dem spouse get, or learn about money habits wey de other person no gree with.

Dey honest, transparent and express your feelings about money to each other. Next, come together to develop plan on how una go move forward with your new financial life together.

Fight on top Sex

fight for sex

E dey easy to take de sexual chemistry wey una both share for granted for de start.  You fit dey tink sey to dey maintain sweet steamy sex life go continue to dey without any miemie. But de truth be sey, many couples go experience small draw back for dem sex lives during de first year of marriage. Drop for passion for sex fit create physical and emotional distance between una. Especially if one partner dey make advance but de other one dey always reject am. While de other go dey feel shame sey dem nor fit satisfy deir partner for dem sexual need.

E dey common for de sexual passion to die down after de wedding and una both go dey unhappy with una sex life. Una both need to siddon yan correct yan on top sex mata. Explore una desires and make una deal with dem feelings of hurt, guilt and anger.

Fight on top Boundaries

fight on top boundaries

Sometimes, if e fit be friend wey drop by de house wiey no tell una before im show. Other times, na de in-laws dey ask unnecessary questions. Some other times, your spouse nor fit to make decision except sey im consult im parents first. Unhealthy boundaries with loved ones fit put k leg for your marriage. E dey important to maintain close relationships with friends and relatives after you don marry. But to dey always give other priority over your spouse go always dey lead to discord for de relationship.

You gat to dey attentive to wetin your spouse want and need on a daily basis, and dem need to do de same for you. You be adults now, and adults dey capable to set solid boundaries. Dem dey put dem spouse and marriage first. All dose fight fight dey dey because one partner value wetin dem family or friends need over wetin deir spouse need.

De "Clean Up After Yourself" Fight

 

clean up after yourself fight

To take decide as una wan take divide de house work fit dey tricky when una just wed. You want to avoid make one person dey feel like sey na dem dey do all de work. But e dey essential for de health of de relationship. In fact, one recent survey find sey 56% of married people say to dey share household chores dey very important for successful marriage.

And when de big share of dese responsibilities come fall on top de shoulder of one partner, hate fit build up, wey go lead to frustrated outbursts and arguments. For our part of de world, na women dey mostly bear de big load for house work, but e nor dey always be like dat every time. You need to discuss and agree upon cleanliness standards. Dis one dey very important so dat una go fit agree on top household standard wey two of una go fit follow.

Read also: Why is my husband ignoring me?

Got a parenting concern? Read articles or ask away and get instant answers on our app. Download theAsianparent Community on iOS or Android now!

img
Written by

Tony S Abiodun

  • Home
  • /
  • Relationship & Sex
  • /
  • Some Common Fights Wey Dey Happen For Early Years Of Marriage
Share:
  • Self-assessment in relationships: would you date yourself?

    Self-assessment in relationships: would you date yourself?

  • How to trust in a relationship: ways to build faith

    How to trust in a relationship: ways to build faith

  • 5 Things To Do When Your Spouse Says Hurtful Things

    5 Things To Do When Your Spouse Says Hurtful Things

  • Want To Save Your Struggling Marriage? These 9 Tips Will Show You How

    Want To Save Your Struggling Marriage? These 9 Tips Will Show You How

  • Self-assessment in relationships: would you date yourself?

    Self-assessment in relationships: would you date yourself?

  • How to trust in a relationship: ways to build faith

    How to trust in a relationship: ways to build faith

  • 5 Things To Do When Your Spouse Says Hurtful Things

    5 Things To Do When Your Spouse Says Hurtful Things

  • Want To Save Your Struggling Marriage? These 9 Tips Will Show You How

    Want To Save Your Struggling Marriage? These 9 Tips Will Show You How

Get advice on your pregnancy and growing baby. Sign up for our newsletter
  • Becoming a Mama
    • Pregnancy
    • Delivery
    • Losing a Baby
  • Ages & Stages
    • Baby
    • Toddler
    • Kids
  • Parenting
    • News
    • Relationship & Sex
    • Parent's Guide
  • Health
    • Allergies & Conditions
    • Vaccinations
    • Diseases-Injuries
  • Feeding & Nutrition
    • Breastfeeding & Formula
    • Latching & Concerns
    • Weaning
  • More
    • TAP Community
    • Advertise With Us
    • Contact Us
    • Become a Contributor


  • Singapore flag Singapore
  • Thailand flag Thailand
  • Indonesia flag Indonesia
  • Philippines flag Philippines
  • Malaysia flag Malaysia
  • Sri-Lanka flag Sri Lanka
  • India flag India
  • Vietnam flag Vietnam
  • Australia flag Australia
  • Japan flag Japan
  • Nigeria flag Nigeria
  • Kenya flag Kenya
© Copyright Africaparent.com 2023 Tickled Media Pte Ltd. All rights reserved
About Us|Team|Privacy Policy|Terms of Use |Sitemap HTML

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it