Africaparent Logo
Africaparent Logo
EnglishSwahili
  • COVID-19
  • Becoming a Mama
  • Ages & Stages
  • Parenting
  • Health
  • Feeding & Nutrition

Corona Virus Wen Don Turn Pandemic: Wetin D World Dey Do About Am

6 min read
Corona Virus Wen Don Turn Pandemic: Wetin D World Dey Do About AmCorona Virus Wen Don Turn Pandemic: Wetin D World Dey Do About Am

Corona Virus Wen Don Turn Pandemic don become matter wen d whole world dey run around dey find cure becos of so.

World Health Organisation don officialli talk sey dis outbreak for Corona Virus wen don turn pandemic dey give efribodi sleepless night. Read The World Health Organisation Calls On Countries To Prepare For A Coronavirus Pandemic.

Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus wen be dia Chief Medical Officer for W.H.O don talk am sey d numba of corona virus case wen dey outside China don increase plenti for d past two weeks.

He talk sey he dey deepli concerned by d way wen e be like sey nobodi dey do anything about d virus.

Corona Virus Wen Turn Pandemic: Wetin Health Organisations Dey Say about Am?

Corona Virus Wen Don Turn Pandemic: Wetin D World Dey Do About Am

Photo credit: Pixabay

Corona Virus wen don turn pandemic don cause plenti death all ova d world and e don turn cause for alarm as dem still neva fit get one cure for am. Pandemic na disease wen dey spread for plenti country around d world at d same time.

Be as e get,  Dr Tedros talk sey just becos dem sey corona virus don turn pandemic no mean sey World Health Organisation (W.H.O) don change d advice wen dem give about wetin different countries fit do to control am. The CDC Warns Of Possible Coronavirus Spread In The US

Wetin be d difference between Epidemic and pandemic

Epidermic na wen disease affect plenti pipu wen dey one area togeda and d disease no dey permanent. ” World Health Organization (WHO) don talk sey epidemic dey happen for level of region or community wen pipu dey stay.

Wen yu compare pandemic to epidemic, pandemic disease na epidemic wen don spread cova plenti area, weda na country, continent or d whole world sef.”

” WHO don define pandemic as spread of new disease worldwide.”  March 11 na wen WHO come outside come delcare sey corona virus na pandemic becos of d way wen e dey take spread all ova d world and d seriousness of d disease.

The World Health Organisation Calls On Countries To Prepare For A Pandemic

Why Na Now Dem Dey Use Dis Kine Word “Pandemic”.

Before now, na just few countries na im dis corona virus first do im outbreak put. But now na evri part of d world don catch am, na im make dem call am pandemic so.

Tedros don challenge all government make dem no dey relaxed for dis kine matter wen dey ground so. He say make “Government change d direction wen dis outbreak dey take so and make dem quick use urgent and aggressive approach. “.

“Plenti countries dem don dey show sey dem fit curtail dis virus wen dey deadli so.” he say.

“D challenge for many countries wen get plenti pipu inside am no be weda dem fit control am now- na weda dem go control dis corona virus wen don turn pandemic so.”

Governments all ova d world come siddon “strike balance between, reduce d wey wen dis corona virus don turn pandemic dey disrupt pipu life and how dem go take respect pipu human rights”.

“We dey dis thing togeda , so make we do d right thing with calmness take protect pipu wen dey all ova d world. Na wetin we go fit do” he say.

Corona Virus Wen Don Turn Pandemic: Wetin D World Dey Do About Am

Source: Aljazeera (Local governments/World Health Organization Last update: March 13, 2020)

How Different Countries Dey React To Di Corona virus Pandemic

For some time now, plenti countries wen been get citizens for china wen corona virus first breakout no even shake bodi as d thing neva concern dem. Now wen e don turn pandemic, all nations don dey run up and down dey find how dem fit curtail am.

Make we see how some nations dey handle am.

Germany

German Chancellor, Angela Merkel been don warn dem for her country sey up to 70% of dia population fit catch dis corona virus wen don turn pandemic- na im be sey some 58 million pipu for Germany -fit catch d disease.

She talk sey since e neva get one particular cure wen dem don bring out, we go focus instead on how we fit reduce d way wen d virus dey take spread. “Na about make we just win time” she talk.

Some German pipu wen dey find cure for virus talk sey d number wen she give too high, sey dat one no dey possible. Former adviser for disease control, Prof Alexander Kekulé, tell media wen dey Germany sey d worst numba of pipu wen he believe sey fit catch d virus na 40,000 cases.

The numba of corona virus victims wen dey for Germany don increase from 1,296 to 1,567 pipu, na so Koch Institute for Infectious disease talk so.

Italy

Italy don get ova 12,000 confirm case of dis corona virus so. D Prime Minister for Italy, Giuseppe Conte, talk sey dem don shut down schools, gyms, museum,night club and oda venues wen crowd fit gada across d country.

Italian Health officials don talk sey pipu wen don die so far don increase from 631-827. Nearli 900 wen get d virus dey intensive care. Na so Michael Ryan wen be head of WHO emergenci unit talk.

Iran

D situation for Iran dey veri serious. Dr Ryan talk sey 354 pipu don die among 9,000 pipu wen get d disease. WHO don send 40,000 kit go Iran but e still no reach. Dem dey short of ventilator and oxygen.

He talk sey “Iran and Italy dey suffer now, but oda countri go soon join d situation.” he said.

 

France

France don talk sey na 48 pipu don die now becos of dis virus. Before na 15 deaths dem been get. Den don confirm sey na 2,281 cases of corona virus outbreak dem get so. Dia Health Minister talk sey dem don place some kine restriction for some areas wen dem suspect sey get  Coronavirus.

Several countries like United States, Rwanda, United Kingdom no dey exempted for dis pandemic so.

China -wen first detect d virus don get  80,754 confirmed cases and 3,136 deaths. But e just record e lowest numba of new pipu wen dey infected and dem just be 19.

Several countries – including Sweden and Bulgaria, as well as the Republic of Ireland – don record dia first death , while d numba of confirm case wen dem get for Qatar don go from 21 reach 262.

For all dis ones wen dey happen so, plenti countries don ground flights worldwide as dem dey try to cope with d demand wen dem don alreadi get.  Some countries don even dey ban foreigners make dem no enta dia countri for now till dis pandemic don break.

Source:BBC

Read also: What Is The Coronavirus? You Don Hear Am Before?

Got a parenting concern? Read articles or ask away and get instant answers on our app. Download theAsianparent Community on iOS or Android now!

img
Written by

Anino Aganbi

  • Home
  • /
  • News
  • /
  • Corona Virus Wen Don Turn Pandemic: Wetin D World Dey Do About Am
Share:
  • Dis Cameroonian Man Na D First African Wen Survive Corona virus For China

    Dis Cameroonian Man Na D First African Wen Survive Corona virus For China

  • Mwanamme Huyu Kutoka Cameroon Awa Mwafrika wa Kwanza Kupona Corona Virus Huko Uchina

    Mwanamme Huyu Kutoka Cameroon Awa Mwafrika wa Kwanza Kupona Corona Virus Huko Uchina

  • The World Health Organisation Calls On Countries To Prepare For A Coronavirus Pandemic

    The World Health Organisation Calls On Countries To Prepare For A Coronavirus Pandemic

  • COVID-19 Pandemic: Italian Couple Celebrate 50th Wedding Anniversary In ICU

    COVID-19 Pandemic: Italian Couple Celebrate 50th Wedding Anniversary In ICU

  • Dis Cameroonian Man Na D First African Wen Survive Corona virus For China

    Dis Cameroonian Man Na D First African Wen Survive Corona virus For China

  • Mwanamme Huyu Kutoka Cameroon Awa Mwafrika wa Kwanza Kupona Corona Virus Huko Uchina

    Mwanamme Huyu Kutoka Cameroon Awa Mwafrika wa Kwanza Kupona Corona Virus Huko Uchina

  • The World Health Organisation Calls On Countries To Prepare For A Coronavirus Pandemic

    The World Health Organisation Calls On Countries To Prepare For A Coronavirus Pandemic

  • COVID-19 Pandemic: Italian Couple Celebrate 50th Wedding Anniversary In ICU

    COVID-19 Pandemic: Italian Couple Celebrate 50th Wedding Anniversary In ICU

Get advice on your pregnancy and growing baby. Sign up for our newsletter
  • Becoming a Mama
    • Pregnancy
    • Delivery
    • Losing a Baby
  • Ages & Stages
    • Baby
    • Toddler
    • Kids
  • Parenting
    • News
    • Relationship & Sex
    • Parent's Guide
  • Health
    • Allergies & Conditions
    • Vaccinations
    • Diseases-Injuries
  • Feeding & Nutrition
    • Breastfeeding & Formula
    • Latching & Concerns
    • Weaning
  • More
    • TAP Community
    • Advertise With Us
    • Contact Us
    • Become a Contributor


  • Singapore flag Singapore
  • Thailand flag Thailand
  • Indonesia flag Indonesia
  • Philippines flag Philippines
  • Malaysia flag Malaysia
  • Sri-Lanka flag Sri Lanka
  • India flag India
  • Vietnam flag Vietnam
  • Australia flag Australia
  • Japan flag Japan
  • Nigeria flag Nigeria
  • Kenya flag Kenya
© Copyright Africaparent.com 2022 Tickled Media Pte Ltd. All rights reserved
About Us|Team|Privacy Policy|Terms of Use |Sitemap HTML

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it