Africaparent Logo
Africaparent Logo
EnglishSwahili
  • COVID-19
  • Becoming a Mama
  • Ages & Stages
  • Parenting
  • Health
  • Feeding & Nutrition

Development And Milestones: Your 6 Months Old Pikin

8 min read
Development And Milestones: Your 6 Months Old PikinDevelopment And Milestones: Your 6 Months Old Pikin

You won't believe what your baby can do at just six months old! She will be chattier, more active and even sleep all night.

Wow!You fit believe sey you and your angel don spend half of one year together, e be like film. You go don dey wonda where all d time go. Now, you don get 6 months old pikin. 

Dis six months so, na big thing for yu and yur pikin. Minus sey change dey for d way wen yur pikin dey follow you play, doktor go tell you say make you start to give am solid food now.

With all dis change wen dey happen so, dis month na time wen you and yur pikin go fit bond well. By now, he go don dey aware of wetin dey happen around am, and he go dey look to see as yu wan take react to him behavior. Yur pikin go do evritin wen he sabi make he for fit get yur attention, so prepare make yu laff. 

6 Months old development : Shey yur pikin dey on track?

6 months old pikin

Physical Development of 6 months old pikin

By now, many pikin go don dey roll from dia back to dia belle. You go see as yur 6 months old don dey prepare for wen he go start to waka. 

Some 6 months pikin dey quick sabi as he go take roll, while some still neva fit roll from dia belle and cry go com start. With all dis rollin so, most pikin fit sleep 6-8 hours through d nite. 

Dis month expect say yur pikin go start to crawl.

No fear if yur pikin no use him knee take crawl, some pikin dey use dia bottom take crawl, some go drag one leg for ground, while odas go use dia belle take crawl. So far yur pikin dey move, yu no get anything to fear.  

By dis age, yur pikin go don dey grab things put for mouth, siddon without any support,  like to dey bounce upandan wen he dey stand, lift hin bodi wen e dey on top him belle.

For dis stage, yur pikin median length and weight* go be:

  • Boys
    – Length: 67.6 cm (26.6 inches)
    – Weight: 7.9 kg (17.5 lb)
  • Girls
    – Length: 65.7 cm (25.9 inches)
    – Weight: 7.3 kg (16.1 lb)

And d size of him head suppose be:

  • Boys: 43.3 cm (17.1 inches)
  • Girls: 42.2 cm (16.6 inches)

Tips

  • Wen yur 6 month old pikin roll on top him belle, make you show am sey yu dey excited. Na dis reaction go make am do more. 
  • Give am toy wen he lie down for him belle, as e go help make he dey used to am. If yur pikin dey ontop bed or any place wen high, make you dey watch am so he no go fall. Once yu wan change diaper, abeg put am for floor make yu for reduce d risk wen he go take wen he roll. 
  • Teach yur pikin tummy time wen na still day time as e go help him muscles dem dey strong.
  • Toys wen dey shake na betta thing for yur pikin hand/eye coordination.
  • Make sure sey you baby proof yur house. Now wen yur pikin don dey crawl, lock evritin wen go fit wound am.
  • Make sure sey all yur bookshelf dey attached well to di wall as yur pikin go wan use am as incentive to take stand.
When yu fit see doktor

If your pikin:

  • Get wahala wen he wan roll
  • No just dey stretch him hand collect anything wen no dey far from am.
  • Be like sey him muscles dem stiff.
  • Nor dey fit put anything for mouth.

 

6 months old pikin

Cognitive Development

By now, yur pikin go don dey see pattern for him nursery rhymes dem and he go wan know wetin happen next. 

You go see sey d way wen yur  6 months old pikin take dey feel things go don  high. He go wan touch any texture wen he see. Yur pikin go start to shift things from one hand to d oda. Dis one na big development. 

Yur pikin eye sight go don improve well well. He go dey attracted to anything wen dey shine, wen get colour join and he go wan drag dem. Make you dey careful with  yur earring!

Tips
  • For daytime, keep yur pikin inside room wen clean and dey bright. Give am toy, make yu allow am grab dem by himself.
  • Take yur pikin go for stroll, and no forget make yu hang toys wen he fit grab for him stroller.
  • Put clean things wen soft like teething ring near yur pikin make yu for fit encourage am make he grab am put for mouth. Commot anything wen fit choke am from wia e dey.

When yu fit see doktor. 

If your pikin:

  • No dey respond to sound or he no dey follow yu wen yu dey inside house.

 

6 month old

Social and Emotional Development

Your 6 months old pikin go dey excited wen she wan follow pipu wen she sabi interract especially as na una wen be her mama and papa, but she fit come fear if any persin wen be stranger near am.

One of yur pikin new hobbi na to dey use yur face take play. In fact, everitin wen she go do, na to get yur attention. 

Tips 
  • Teach yur pikin games wen she go fit copy yu. 
  • Play fun games like sey yu dey mimic wetin he dey talk, den make animal sounds for am make e mimic yu. 
  • Help yur pikin develop him language skill, show am picture of animals, say d name of d animal dem, den make d sounds with yur pikin. 
When yu fit see doktor

If yur pikin:

  • Nor dey respond to d persin wen dey take care of am, or e no dey interested for things wen dey happen around am.

6 months old pikin

Speech and Language

Oya, bring yur camera come out. As yu don get 6 months old pikin so, na evritin wen yu talk na im yur pikin go repeat. Yu fit hia words loke ma-ma. da-da.  

Yur pikin feel sey he dey communicate well with all d baby talk and d plenti laff, so make sure sey yu sef encourage am with yur response. 

Tips 
  • As yur pikin dey talk, make yu dey nod like sey yu sabi wetin he dey talk. Or yu point d things wen he dey look, call d name. E go help am develop him language skill.
  • Anoda way to take help yur pikin language skill na to dey talk about wetin yu dey do for im front. Yu fit think sey e go make yu look stupid to dey talk about wetin yu dey do come out, but all dose words dey register for yur pikin brain. 
  • Na normal tone make yu use take follow yur pikin talk.
  • Make yu call things by dia normal name. No go call milk mi-mi.

6 month old pikin

When yu fit see doktor

If your pikin:

  • Nor fit make sound like 'aa', 'oh' 'eh'
Health and Nutrition

For dis stage, yur 6 months old pikin go don dey ready make you wean am. Now, yu fit start to dey give am formula and from dere, yu fit give am fruits and vegetables. 

By now, yur pikin suppose dey weigh 7.1 to 8.8 kgs and him height suppose dey  61 to 69.8 cms. So if yur pikin get small body and he dey do well, den yu no get need to fear.

Dis month, yur pikin go don collect him third dose of 6 in 1 vaccine and him second dose of PCV. Make sure sey yu follow yur pikin doktor talk if yu no dey sure about d vacccine wen yur pikin suppose take.

Tips
  • Introduce new food give yur pikin one afta d oda, give space of few days make yu fit check weda yur pikin dey react to am or not. 
  • No think sey yur pikin dey allergic just becos he no like d food wen yu give am. Pikin dey sabi select food well well. So, make yu try new food pass two days as e go help am dey used to new food. 
  • To start with, yu fit give yur pikin avocado, banana, papaya and sweet potato.
  • If yu wan to avoid purees, try baby led weaning.
  • Remember sey milk na still yur pikin primary source of nutrient for d months wen dey come. So yu no need fear say yu must give am solid food from start. If yu start with one spoon, dat one don reach.
  • Nor give yur pikin solid if sleep dey catch am or he dey hungry. D best time na wen he just sleep wake up, or in between feed time.
  • Make yu continue to dey breastfeed, if yur pikin shit too strong as yu dey give am solid so, yu fit give am water after yu don feed am.
  • American Academy of Pediatrics talk say no link dey between allergy and wen yu dey give pikin egg or fish, but make yu avoid honey and milk for anoda 6 months.

Wen yu fit see doktor

If your pikin

  • Start to dey lose weight
  • No dey follow d regular measurement for height and weight
  • Dey get rashes once he just eat new food.

 

*Disclaimer: This is the median length and weight, and head circumference according to WHO standards.

Sources: WebMD

Previous month: Baby development and milestones: your 5 month old

Next month:

Republished with permission from theAsianparent

Got a parenting concern? Read articles or ask away and get instant answers on our app. Download theAsianparent Community on iOS or Android now!

img
Written by

Anino Aganbi

  • Home
  • /
  • Ages & Stages
  • /
  • Development And Milestones: Your 6 Months Old Pikin
Share:
  • Baby development and milestones: your 6 month old

    Baby development and milestones: your 6 month old

  • Baby development and milestones:Your 4 Months Old Pikin

    Baby development and milestones:Your 4 Months Old Pikin

  • Baby development and milestones: your 10 month old

    Baby development and milestones: your 10 month old

  • Baby development and milestones: your 4 month old

    Baby development and milestones: your 4 month old

  • Baby development and milestones: your 6 month old

    Baby development and milestones: your 6 month old

  • Baby development and milestones:Your 4 Months Old Pikin

    Baby development and milestones:Your 4 Months Old Pikin

  • Baby development and milestones: your 10 month old

    Baby development and milestones: your 10 month old

  • Baby development and milestones: your 4 month old

    Baby development and milestones: your 4 month old

Get advice on your pregnancy and growing baby. Sign up for our newsletter
  • Becoming a Mama
    • Pregnancy
    • Delivery
    • Losing a Baby
  • Ages & Stages
    • Baby
    • Toddler
    • Kids
  • Parenting
    • News
    • Relationship & Sex
    • Parent's Guide
  • Health
    • Allergies & Conditions
    • Vaccinations
    • Diseases-Injuries
  • Feeding & Nutrition
    • Breastfeeding & Formula
    • Latching & Concerns
    • Weaning
  • More
    • TAP Community
    • Advertise With Us
    • Contact Us
    • Become a Contributor


  • Singapore flag Singapore
  • Thailand flag Thailand
  • Indonesia flag Indonesia
  • Philippines flag Philippines
  • Malaysia flag Malaysia
  • Sri-Lanka flag Sri Lanka
  • India flag India
  • Vietnam flag Vietnam
  • Australia flag Australia
  • Japan flag Japan
  • Nigeria flag Nigeria
  • Kenya flag Kenya
© Copyright Africaparent.com 2023 Tickled Media Pte Ltd. All rights reserved
About Us|Team|Privacy Policy|Terms of Use |Sitemap HTML

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it