Maternity hospital na de hospital wey specialise on how to take care of dem women wey get belle or wey just born pikin. No be only dem women de hospital dey care for, e dey take care of d pikin when im still dey inside im mama and after im don show face for de world. Plenty hospital like dis dey around us, we don compile dem 10 best maternity hospitals for Naija.
Wen de belle don enta, mama and pikin need proper care. Dis care must to dey from de time wey belle enta till when dem born de pikin, and even till some months after de pikin don land for dis world. To choose maternity hospital wey get doctors and midwives wey sabi dey very important for de health of de mama and pikin. We for don avoid many death wen women dey born if to say na people wey sabi dey helep women before dem born and wen dem dey born.
Na our List of 10 Best Maternity Hospitals for Naija be dis:
-
Lagos Island Maternity Hospital

Managed by Lagos state government, dis hospital tanda gidigba for de Island and e don dey deliver awesome service since 1960, no be play play.
Pros
- You go fit get 24 hour maternity service, and service dey affordable for all classes (rich or poor).
- Dem get doctors and midwives wey get beta experience
- De service wey dem dey deliver na quality
- Dem get enough modern facilities wey fit helep mama and pikin
Cons
None
Contact: 08075593741, [email protected], www.islandmaternity.com
Address: Lagos Island Maternity Hospital, Campbell Street, Lagos

Dis na de most popular hospital for Abuja. De main reason why dem establish de hospital na to take care of mama and pikin for Naija and for other West Africa country dem. E don dey since 1999 and e dey deliver awesome health care for mama and pikin.
Pros
- You go fit get 24 hour maternity service.
- Their service dey affordable for all classes (rich or poor)
- De place get doctors and midwives wey get beta experience
- Their service wey dem dey deliver na quality
- Dem get enough modern facilities wey fit helep mama and pikin
Cons
None
Contact: 08037879543, [email protected], https://nationalhospital.gov.ng
Address: Plot 132 central business district (phase II) PMB 425, Garki, Abuja

Na dem be de current private healthcare group wey big pass for Naija. Dem don dey offer standard health care service for obodo Naija since 1986.
Pros
- De place get world class service
- Dem dey accredited by dem Joint Commission International
- De place get enough modern facilities wey fit helep mama and pikin
- Dem get enough experience on to maternity mata
- Their service dey affordable
Cons
None
Contact: 08082094409, [email protected], lagoonhospitals.com
Address: 17B Bourdillon Road Ikoyi Lagos

One of dem best hospitals for Abuja. Limi don dey in service since 1982. Located for four locations for Abuja, dem dey offer variety of health care service to both young and and old.
Pros:
- Dem get world class service
- De place dey offer multi-special family healthcare
- Dem get enough modern facilities wey fit helep mama and pikin
- De place get enough experience for maternity matter
Cons:
E nor dey affordable for everybody. E cost.
Contact: 08090160174, [email protected], limihospital.net
Address: Limi Complex,1487, Off Constitution Avenue, Behind ICPC/NDIC, Central Business District, Abuja-FCT
-
Reddington Hospital, Lagos

Dem get various awards to dem credit- Council for Hospital Services Accreditation of Southern Africa and NHEA Private Healthcare Provider for Nigeria. Dis na proof of de quality of dem service.
Pros
- Dem get world class service
- De place get several awards for quality of service
- Dem get enough modern facilities wey fit helep mama and pikin
- De place get enough experience on to maternity mata
Cons
You go spend money, e nor cheap.
Contact: +234(0)12715341, [email protected], reddingtonhospital.com
Address: 12 Idowu Martins Street, Beside Mega Plaza V.I, Lagos

One of dem 10 best maternity hospital for Naija. Expert for mama and child care with enough experience around West Africa.
Pros
- Dem get world class service
- De hospital dey available all day round
- Dem get enough modern facilities wey fit helep mama and pikin
- De place get enough experience on to maternity matter
Cons
Dem service fit nor dey affordable for some people
Contact: 08035251295, [email protected]lashospital.com, https://saintnicholashospital.com
Address: 57 Campbell Street, Lagos Island

Dem dey passionate about education and health care and dem dey provide one of de best health care service for mama and pikin. For dis reason, we add dem to de list of 10 best Maternity Hospital for Naija.
Pros
- Dem get world class service
- De place dey available all day round
- Dem get enough modern facilities wey fit helep mama and pikin
- De hospital get enough experience on to maternity matter
Cons
De cost no be here o! E cost!
Contact: 08056339444, [email protected], nizamiyehospital.com.ng
Address: Plot 113 Cadastral Zone, Life Camp, Abuja
-
Save a Life Hospital, Rivers

Dis hospital dey driven by de goal to reduce as we take dey comot Naija for medical treatment as dem dey provide similar service for Naija. Na good place for mama and pikin wen belle dey and to deliver safely.
Pros
- Dem get world class service
- De place dey offer multi-special family healthcare
- Dem get enough modern facilities wey fit helep mama and pikin
- De place get enough experience on to maternity mata
Cons
No be everybody fit afford dem
Contact: 08100000651, [email protected], https://www.savealifehospital.com
Address: 38 Uyo Street Off Stadium Rd, Rumuomasi, Port Harcourt, Rivers
-
First Rivers Hospital, Rivers

Dem main objective na to preserve life wey include mama and pikin through quality medical service.
Pros
- Dem get highly specialised service
- De service include care for mama and pikin
- E get enough modern facilities wey fit helep mama and pikin
- Dem get enough experience on to maternity matter
Cons
De money fit dey high small.
Contact: 08158493600, [email protected], firstrivers.com
Address: 7/9 Old Aba Road, Portharcourt, Rumuomasi, Port Harcourt, Rivers

Dem don dey since 1984 and dem get hospital for 2 states for Naija. Dem mission na to deliver health care service wey focus on de patient
- De people service na baba, dem get highly specialised service
- Their service include care for mama and pikin
- Dem get enough modern facilities wey fit helep mama and pikin
- De people get enough experience on to maternity mata
Cons
The price fit be issue for some people.
Contact: 07053351741, [email protected], lilyhospitals.com
Address: 6, Brisibe Lane, Off Etuwewe Road, Off Deco road, Warri-Delta State
When you wan choose the maternity hospital for yourself or wife, shine your eye for de services and de cost. From dis list of 10 best maternity hospital for Naija, you fit make your choice. You fit also compare various hospital to check de quality of service, de patient-doctor relationship, de environment, de facilities and de cost. Safe delivery to all dem mama wey dey expect pikin soon.
Read this tori join: Best Lactation Consultants In Lagos