Yu dey find unique names for girl pikin among all di best names wen dey di world, make yu no just check top American names o. Some names dey wen di meanings go trip yu. So make you look girl names from different countries like: Aurora (Norway), Mei (Japan), Lesedi (South Africa), Catalina (Argentina), and Sienna (Australia). Di way wen dese names dey sound dey unique. Yet di fact sey dem dey universalli accepted na im make yu fit use dem for any part of di country wen yu dey, no matta di culture wen yu dey practice.
Pipo get different reason why dem dey pick names wen dey common for anoda part of di world.
“Some parents dey wen dem wan honour part of dia ancestori. Sometimes yu go even see sey di pikin last name fit be from anoda culture, but di parents go wan use di first name take honor different culture” na Laura Wattenberg of Baby Name Wizard talk am. “Or maybe dem just wan show pride for dia culture. ”
But Wattenberg also talk sey e no dey compulsory make yu get heritage from one country to fit use names wen dey common dia.
We no fit meet person wen dey ansa one name, make we come dey assume sey he come from one particular place. All dese names just dey give parents fresh ideas.
Wetin parents wen dey oda countries come dey name dia pikin? We dey lucky sey, Wattenberg and her team get statistics for plenti different countries. We go through dia list make we fit see 50 names wen dey hot for oda part of di world wen go dey perfect for any girl pikin.
Yu fit check out our 50 unique names for girl pikin, we try make we pick names from different countries. Wattenberg talk sey no be efiri country dey make dia official names data dey public, so no be efiri country dey represented for hia. But still, we try to go round gada some unique names for girl pikin.
We hope sey yu go fit see unique names for girl pikin for yur future world travella inside dis list.
See our list of unique names for girl pikin hia:
Camille
Image source: CafeMom
Dis one na one version of Camilla, but Camille dey chic pass. Di meaning na “pure” or ” characta wen no get stain”. Na common name choice for Quebec and oda countries wen dey speak french.
Farah
Image source: CafeMom
Ahhhhh! Dis one mean “joy” for Arabic. So if yu dey think of perfect Arabic girl name, Farah dey beautiful for yur girl pikin.
Aurora
Image source: CafeMom
Dis one sweet me. And come be Latin name for “dawn”, di name Aurora go make yu imagine di natural beauty of aurora borealis. Di name dey popula for Norway and oda European countries.
Mei
Image source: CafeMom
Mei dey short and sweet. Na one of dia top 10 names for Japan, for dia e mean “bud” or “sprout”( make something grow) but for China, e mean “beautiful.”
Tess
Image source: CafeMom
Before, Tess na nickname for Theresa wen mean “harvesta”. But now, e don come dey popula sey na im dem dey give girl pikin as full name. Na veri common name for Netherland.
Lesedi
Image source: CafeMom
Dis one na one of di top common names for South Africa and e mean “light” for Tswana.
Image source: CafeMom
Dis one na fine altanative to di name Maya. Amaia mean “the end” for basque and e dey common for Puerto Rico.
Freya
Image source: CafeMom
Freya na di goddess of fertiliti inside Norse mythology. Di name na one of di commonli used girl name for Wales and e dey common throughout UK.
Catalina
Image source: CafeMom
Catalina na Spanish name for Catherine, wen mean “pure” or “unsullied.” E dey popula for Argentina and Chile.
Aoife
Image source: CafeMom
Irish names dey hard make Americans pronounce. But with dis name dem dey pronounce am as — EE-fa . E just be like Eva but with di “F”. Na Gaelic name wen mean “beauty.”
Nina
Dis name na currentli di second most popula name for girl pikin for Slovakia. Nina na di Russian nickname for Anne and Antonia.
Aisha
Image source: CafeMom
Mean”alive” for Arabic, Aisha na one of di most popula name for girl pikin for Kazakhstan.
Tamar
Image source: CafeMom
Tamar na currrentli di numba one name for Israel. E mean “palm tree” for Hebrew.
Isidora

Isidora na perfect name for parents wen like Isabel but want di version wen no too common for US. Na common name for Chile and na combination of Egyptian goddess of fertility name (Isis) and one Greek word wen mean “gift.”
Ramona
Image source: CafeMom
Ramona na di female version of Ramone, wen mean “wise protection.” And na one of di top names for Paraguay.
Sienna
Image source: CafeMom
Sienna na brownish orange-red color and na also type of clay wen get di same colour. Na popula name for different parts of Australia.
Tui

Tui (pronounced Twee) na dorable name for girl pikin and e dey popular for New Zealand. Na Maori word for one kine bird.
Zahra
Image source: CafeMom
Zahra mean “brilliant” or “bright.” Na currentli di numba one name wen dem dey use for Azerbaijan for girl pikin.
Astrid
Image source: CafeMom
Dis na name wen dey common for girl pikin inside Sweden and Denmark, Astrid na compund name wen mean “a god” and “beautiful” or “fair.”
Venla

Venla no be common name but e dey easi to pronounce. Na di female version of Wendel, wen mean Vandal, di name na from fifth-century Germanic tribe. Na common name for girl pikin for Finland.
Yuna

Yuna na fine name wen dey easi to pronounce. Na one of di common names for Japanbut oda countri sef dey use am for dia girl pikin.
Valentina

Dis name just dey too romantic!Wen yu hia di name Valentina, yu go think of Valentine day. Dis name dey common for girls wen dem born for Mexico and oda countries wen dem dey speak Spanish.
Ines
Image source: CafeMom
Ines na di fench version of Inés or Agnes, and e dey among di top ten names wen dem dey give girl pikin for France. Dis fine name na betta choice for parents wen like French names but no wan use di ones wen dey too common for US.
Defne

Defne na popula Turkish name wia na variant of Daphne wen mean “bay leaf” or “laurel”
Luciana
Image source: CafeMom
Dis na di top second Columbia name for girl pikin. Luciana na name wen Itali, Portuguese and oda countri wen dey speak Spanish dey use.
Julieta

Dis one na popula name wen dose for Uruguay dey give girl pikin. Julieta na anoda form of Julie or Juliet.
Noemi
Image source: CafeMom
Dis na di Spanish version of Naomi, and for Hebrew, e mean “my delight”. Dis name dey popula for Itali, and oda European and South American countries.
Tia

Tia na dis short form of Letitia, wen mean “happiness” but e get different meanings for different languages wen dey use am.
Mariana
Image source: CafeMom
Mariana na combination of Maria and Ana. And di name come from Roman god of War (Marianus). Di name dey popular for Portugal.
Daniela
Image source: CafeMom
Daniela na di female version of top 10 girl names for Spain.
Matilda
Image source: CafeMom
Matilda na popular name for girl pikin for different part of of Australia and Tasmania. Yu go see sey different part of di world dey give dia pikin Matilda. Matilda mean”powerful for battle”.
Marija
Image source: CafeMom
Di J dey silent for dis Slovene version of Maria/Mary. Dem dey use am for Bulgaria and Croatia well well.
Luisa
Image source: CafeMom
Luisa come from Louis, wen mean “famous for war.” Yu fit find girls wen dey ansa dis name for Germany and oda European countries.
Ana
Image source: CafeMom
Ana mean “gracious” or “merciful.” Na numba one name wen Australians dey give dia girl pikin. And e dey common for Spain, Portugal, Switzerland, Serbia, and oda countries.
Nora
Image source: CafeMom
Nora na short form for Honora (wen mean “honor”) or Eleanor (wen mean “light”). NA different languages of di world dey use am.
Sóley

Sóley, which is the word for buttercup, a yellow wildflower.
Isla
Image source: CafeMom
Isla na one of di top girl name for Scotland and England. And na name of one of Scottish Island.
Yasmine
Image source: CafeMom
Yasmine na Arabic name for sweet-smelling jasmine bush. Yasmine dey common for Belgium, France, and Quebec.
Adele
Image source: CafeMom
Adele na di short form of Adelaide, and e mean”nobility.” E dey among di top 10 names for France.
Liliana
Image source: CafeMom
According to Baby Name Wizard, Liliana mean “lily.” E dey common for Poland, Hungary and Portugal.
Mila
Image source: CafeMom
Mila dey among di top girl names for Switzerland and e mean “gracious, dear.” E also dey common for oda countries.
Tereza
Image source: CafeMom
Dis one na one of di top names for Czech Republic,and dem dey spell am with “Z” instead of di regular theresa, and e mean “harvesta.”
Alise
Image source: CafeMom
Alise na Alice for Latvia, and e dey among di popular names wen dem dey give girl pikin.
Bianca Maria
Image source: CafeMom
Bianca mean “white,”while Maria na “Mary.”Wen dem combine di two togeda, e dey form sweet name wen Romania pipo dey use for dia girl pikin.
Polina
Image source: CafeMom
Polina na di female version of Paul and e mean “small”. Dis one dey among di top names wen dey common for Belarus for girl pikin.
Katarina
Image source: CafeMom
Katarina na one of di best girl name for Serbia, and e dey veri common for US. NA one version of Katherine wen mean “Pure.”
Linnea
Image source: CafeMom
Linnea dey among di top 10 names for Sweden. Na name of flowa wen one botanist for Sweden name afta himsef.
Aylin
Image source: CafeMom
Aylin (wen den dey pronounce as Eileen) mean “something wen be part of di moon.” E dey popola for Turkey and Azerbaijan.
Anastasia
Image source: CafeMom
Anastasia mean “of di resurrection” and e dey popula among Eastern Orthodox Christians. Dis name dey among di top names wen dem dey use for Russia, Ukraine, and Georgia.
Also read: The most unique names with Biblical meanings for girls
This article was first published on CafeMom and was republished on theAsianparent with their permission.
Translated By Anino Aganbi