Africaparent Logo
Africaparent Logo
EnglishSwahili
  • COVID-19
  • Becoming a Mama
  • Ages & Stages
  • Parenting
  • Health
  • Feeding & Nutrition

Pikin drown inside bucket of water: How you fit prevent drowning accidents

3 min read
Pikin drown inside bucket of water: How you fit prevent drowning accidentsPikin drown inside bucket of water: How you fit prevent drowning accidents

Dem no supervise d pikin wen he drown...

Pikin dem dey curious about de world around dem. As dem dey grow dem physical skills, your home become one exciting world wey dem fit explore, but e fit also be dangerous place for pikin wey dem nor supervise. Dem fit get into trouble for de most unexpected places – dis include drowning for home. So e dey important make parent know how to prevent drowning accidents for home.

E never tey wen one small pikin drown for home inside bucket of water, reminding parents sey e dey important to know how to prevent drowning accidents for home as well as for outside.

How to prevent drowning accidents: Small pikin drown inside bucket of water for home

14 months baby drowned

One 14-month old small pikin drown, after im jump for inside bucket of water for home.

Him mama rush enta de toilet wen she dey hear sounds of water wey dey splash and find sey her pikin don kpeme. De little boy take head enter inside de bucket. Immediately she call her husband for helep. De couple dey chop wen de tin happen.

She claim sey de bucket dey empty as she dey use am to bath de pikin older sibling earlier for dat day.

Dem rush de boy go one health clinic but medical officers confirm sey im don die. Dem classify de case as sudden death.

Na only diapers de boy dey wear and dem no find external injuries on de boy. Police  no find evidence of crime or foul play, but investigation continue.

How to prevent drowning accidents from happening at home

De most important tin on how to prevent drowning accidents for home – never leave your child unsupervised

E dey very easy for babies and toddlers to drown. In fact, dem fit drown inside water wey dey as low as 2.5cm and e fit happen under one minute. So, nor be just only inflatable pools and children’s pools fit pose as a risk, but also tins wey you no expect like bathroom sinks and buckets of water.

Always supervise your small pikin for inside de bathroom.

Here na how to prevent drowning accidents from happening for home:

  1. Nor dey ever leave your pikin alone inside bathroom.Even if emergency dey wey you need to attend to for your home, e fit be sey you wan answer de door or pick up a house call, you fit wan wrap your baby inside towel and carry de baby with you to wetin you need to do. Nor dey expect sey your pikin older sibling go keep watch – even one slight slip fit prove fatal.
  2. As long as you get pikin for inside house, nor leave any water wey full up for home. Dis include buckets, tubs, and any containers whether na bathroom or na kitchen e dey.
  3. If possible, you fit install toilet seat locking device to keep de toilet lid closed. Otherwise, always remember to keep de bathroom door closed, and remind your other pikin too.
  4. Only use bathtub seats and supporting rings for your pikin under your direct supervision.Dese seats fit dey slippery or e fit overturn, your pikin fit accidentally slip inside e water.

Take a first aid and CPR course

How to prevent drowning accidents – learn baby and child first aid and CPR | Source: Adobe Stock

Spare de time to learn CPR and child first aid care so you go fit act quickly to save your pikin for emergency.

Read also: Afrobeats Star D’banj Loses Son In Swimming Pool Drowning: Pool Safety Tips

Source: New Straits Times, KidsHealth, ParentLink, National First Aid Academy, Getaway

Got a parenting concern? Read articles or ask away and get instant answers on our app. Download theAsianparent Community on iOS or Android now!

img
Written by

Tony S Abiodun

  • Home
  • /
  • Parent's Guide
  • /
  • Pikin drown inside bucket of water: How you fit prevent drowning accidents
Share:
  • Toddler drowns in bucket of water

    Toddler drowns in bucket of water

  • Your Pikin Back To School Hair Styles For Girls Dem

    Your Pikin Back To School Hair Styles For Girls Dem

  • Covid-19: 12 Indoor Activities For Pikin During Coronavirus Outbreak For Naija

    Covid-19: 12 Indoor Activities For Pikin During Coronavirus Outbreak For Naija

  • How To Keep Your Child Safe From Drowning At Home

    How To Keep Your Child Safe From Drowning At Home

  • Toddler drowns in bucket of water

    Toddler drowns in bucket of water

  • Your Pikin Back To School Hair Styles For Girls Dem

    Your Pikin Back To School Hair Styles For Girls Dem

  • Covid-19: 12 Indoor Activities For Pikin During Coronavirus Outbreak For Naija

    Covid-19: 12 Indoor Activities For Pikin During Coronavirus Outbreak For Naija

  • How To Keep Your Child Safe From Drowning At Home

    How To Keep Your Child Safe From Drowning At Home

Get advice on your pregnancy and growing baby. Sign up for our newsletter
  • Becoming a Mama
    • Pregnancy
    • Delivery
    • Losing a Baby
  • Ages & Stages
    • Baby
    • Toddler
    • Kids
  • Parenting
    • News
    • Relationship & Sex
    • Parent's Guide
  • Health
    • Allergies & Conditions
    • Vaccinations
    • Diseases-Injuries
  • Feeding & Nutrition
    • Breastfeeding & Formula
    • Latching & Concerns
    • Weaning
  • More
    • TAP Community
    • Advertise With Us
    • Contact Us
    • Become a Contributor


  • Singapore flag Singapore
  • Thailand flag Thailand
  • Indonesia flag Indonesia
  • Philippines flag Philippines
  • Malaysia flag Malaysia
  • Sri-Lanka flag Sri Lanka
  • India flag India
  • Vietnam flag Vietnam
  • Australia flag Australia
  • Japan flag Japan
  • Nigeria flag Nigeria
  • Kenya flag Kenya
© Copyright Africaparent.com 2023 Tickled Media Pte Ltd. All rights reserved
About Us|Team|Privacy Policy|Terms of Use |Sitemap HTML

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it