You don notice sey you dey attracted to one person? E don ever happen to you sey you dey always dey very emotionally excited wen you dey with dat person? Romance na dat emotional feeling or attraction wey one person dey share with another person. Dis kain feeling dey always high wen relationship or marriage still dey new. As time dey go for inside relationship or marriage, de emotional feeling or attraction fit dey reduce small small. Sometimes wen una don know each other finish, de romance dey drop. You go need some hot tips to revive romance for your marriage.
Eleven hot tips to revive romance for your marriage

1. You suppose gum body well
Wen body gum body, e dey helep make two people bond wella. According to wetin Danielle Friedman yan from The Burgeoning Field of Touch Research, affectionate touch between couples dey helep promote de feeling of bonding and attachment. No be only dat, e dey helep couples for dem health and well-being too. Make una dey touch each other to build bond and ease stress.
2. Nor dey play with sex
E dey very important make husband and wife understand each other wella, especially on top sex mata. Wen one party dey always want am and de other person nor dey gree give, e fit make romance dey die small small. Make two of una reach agreement on how una wan take dey handle sex- talk about am and put una talk to action to helep ignite de fire of intimacy.
3. Change sex style
E good make husband and wife dey explore different kind of sex style. E nor go make una sex life dey boring. Make una dey spend time with touching and romance before de real tin. Make una try different pattern and catch fun, e go helep revive romance for your marriage.

4. Go on date once once
Sometimes wen couples don marry and dem don dey spend some time together, dem dey always forget to take each other out for date. Dem go dey busy with work and other activities and dem go forget how to treat demselves to good meal at de popular restaurant wey dem bin dey go wen dem still dey date. Take your partner on a date once once, e fit be to go eat out, see movie, attend comedy show or concert- e go helep revive romance for your marriage.
5. Talk about issues
If any issue dey between una, make una dey find time to discuss am. E nor go make sense make husband and wife dey inside house and dem nor dey talk to each other because dem dey fight. E good make una dey talk mata together and address issues wey fit dey between una with respect.
6. Celebrate una love
Set one date for de year wen una go dey celebrate una love together. Una fit do de celebration for una home with minimum budget or una fit go on vacation where only two of una go spend time together and enjoy life. Na so love and romance take dey dey stronger.

7. Spend more time with each other
Una romance fit dey drop because una no dey really spend time together again as una dey do before. To bring back de romance, make una dey try find time to dey dey together and talk together.
8. Learn more about each other
We dey always learn new tins about each other day by day. Ask questions and explain yourself wen e be like sey de other person no understand you.
9. Nor forget de word “I love you”
If you truly mean am and you don already commit yourself to be with your partner, nor forget de word “I love you”. Remember to talk am before you commot for house, remember to talk am wen una dey on call, you fit even write am for greeting card to give your partner.
10. Make peace dey more important
Sometimes una go argue- na normal tin for people wey dey live together. But always dey try allow make peace dey reign. Sometimes you no need to admit sey you dey right just to make peace reign.
11. Play together
To helep revive romance for your marriage, always play and laugh together. Couples wey dey playful dey always dey happy.
Love and affection dey important for family. E go take de effort of both parties to take revive romance for una marriage. If your romance don dey drop, time don reach to take action.
FB title- 11 tips to bring romance back in your marriage
Meta description-