Africaparent Logo
Africaparent Logo
EnglishSwahili
  • COVID-19
  • Becoming a Mama
  • Ages & Stages
  • Parenting
  • Health
  • Feeding & Nutrition

Zimbabwe Woman Tererai Trent Say She Dey 'Humbled' With Her Statue For New York

4 min read
Zimbabwe Woman Tererai Trent Say She Dey 'Humbled' With Her Statue For New YorkZimbabwe Woman Tererai Trent Say She Dey 'Humbled' With Her Statue For New York

Dem don launch one statue of one  Zimbabwe akada woman, Tererai Trent for New York. Na for Women’s Equality Day for August 26, 2019, dem launch di statue. Dem say di woman na one of di 10 most inspiring women for dis world.

Tererai Trent Tok Say She Dey Humbled No Be Small

She tell BBC say: “I dey veri humbled —I no fit believe am. You fit believe say na me dey for New York City? We know say 3% of statues in the city be woman. My great-grandmother, my grandmother, my mother — ha! — dem no for ever fit dream say dis kain tin fit happen.”

What silenced us?
Consider this question and remember…every generation of women who accepts silencing as the norm…normalizes it for the next generation–are you willing to remain stifled from your dream and remain silenced? pic.twitter.com/gBKSTvyW0H

— Dr. Tererai Trent (@TereraiTrent) August 27, 2019

She write for Twitter say:

Wetin silence us?
Think am well make you remember…every generation of woman wey accept silencing as die way…go accept am for di next generation–you wan dey oppressed for your dream and remain silent ? pic.twitter.com/gBKSTvyW0H

— Dr. Tererai Trent (@TereraiTrent) August 27, 2019

Her statue folow go up with some oda women own. Di women na media woman Oprah Winfrey, Hollywood star Nicole Kidman and Cate Blanchett. Dis woman also folow dey – conservationist Jane Goodall, with activist Janet Mock, and chemist Tracy Dyson. Den come add author Cheryl Strayed, and Olympic gymnast Gabby Douglas.

Dem dey honour di women sake of say dem dey fight for gender equality for girls and women. Na for May 2019 dem first name dem di ‘World’s top 10 most inspiring women’.

Make Una Know Small About Di Woman Tererai

When she bi pikin for Zimbabwe, dem no gree for Trent to go skool o. Dem say na becos she be woman. She tell BBC say:

“For di whole village, na only men sabi read and count, and many of di women no sabi. And some of dem brilliant no be small.”

History being made in NewYork Doctor Tererai Trent @TereraiTrent statue unveiled for humanitarian work in [email protected] [email protected] pic.twitter.com/3y6XMsIuro

— Marvellous Nyahuye (@marvellousvibes) August 26, 2019

Di woman try make sure say she achieve her dream, she go school laslas.  Now she don get degree for Agric education. She still com get masters degree and PhD from College of Public Health for Western Michigan University.

Now, the dis akada woman don write book and she dey helep to give back. She dey helep woman and girls wey wan go school for village, make dem go. As she tok, “We get moral duty, those of us wey fit achieve our dreams, for help others to stand on top our shoulder make we sef give dem dat opportunity.”

Na Trent and di remaining nine women be di first people wey di artists dem go sculpt. Di artists na Australian artists Gillie and Marc Schattner. Dem choose di women through public vote wey dey part of their global campaign wey dem dey call Statues For Equality. Di campaign aim na to increase di statue of woman wey dey dis world.

We celebrated #WomensEqualityDay by launching #StatuesForEquality portraits at City Point with women empowerment leader, @TereraiTrent and the artists themselves @GillieAndMarcArt.

These ten paintings is now open to the public at City Point! ♥️ pic.twitter.com/WI2EzJxOCj — City Point (@CityPointBKLYN) August 27, 2019

Di artists dem tok say dem “hope say as di project expand, e go get bigger diversity of race, class, ability, sexual orientation and gender expression.”

Pulse NG

Read dis tori join:  This Mathematics Teacher Uses Igbo And Pidgin To Teach Her Students

 

 

Got a parenting concern? Read articles or ask away and get instant answers on our app. Download theAsianparent Community on iOS or Android now!

img
Written by

AyeeSha

  • Home
  • /
  • News
  • /
  • Zimbabwe Woman Tererai Trent Say She Dey 'Humbled' With Her Statue For New York
Share:
  • Nigerian homeless refugee child wins New York chess championship

    Nigerian homeless refugee child wins New York chess championship

  • Husband refuses to divorce wife until she pays him 3.5 million

    Husband refuses to divorce wife until she pays him 3.5 million

  • Were these Kenyan teenage girls switched at birth?

    Were these Kenyan teenage girls switched at birth?

  • See This Touching Video Wey Nigerian Celeb Flavour Dey Entertain Im Papa For Enugu

    See This Touching Video Wey Nigerian Celeb Flavour Dey Entertain Im Papa For Enugu

  • Nigerian homeless refugee child wins New York chess championship

    Nigerian homeless refugee child wins New York chess championship

  • Husband refuses to divorce wife until she pays him 3.5 million

    Husband refuses to divorce wife until she pays him 3.5 million

  • Were these Kenyan teenage girls switched at birth?

    Were these Kenyan teenage girls switched at birth?

  • See This Touching Video Wey Nigerian Celeb Flavour Dey Entertain Im Papa For Enugu

    See This Touching Video Wey Nigerian Celeb Flavour Dey Entertain Im Papa For Enugu

Get advice on your pregnancy and growing baby. Sign up for our newsletter
  • Becoming a Mama
    • Pregnancy
    • Delivery
    • Losing a Baby
  • Ages & Stages
    • Baby
    • Toddler
    • Kids
  • Parenting
    • News
    • Relationship & Sex
    • Parent's Guide
  • Health
    • Allergies & Conditions
    • Vaccinations
    • Diseases-Injuries
  • Feeding & Nutrition
    • Breastfeeding & Formula
    • Latching & Concerns
    • Weaning
  • More
    • TAP Community
    • Advertise With Us
    • Contact Us
    • Become a Contributor


  • Singapore flag Singapore
  • Thailand flag Thailand
  • Indonesia flag Indonesia
  • Philippines flag Philippines
  • Malaysia flag Malaysia
  • Sri-Lanka flag Sri Lanka
  • India flag India
  • Vietnam flag Vietnam
  • Australia flag Australia
  • Japan flag Japan
  • Nigeria flag Nigeria
  • Kenya flag Kenya
© Copyright Africaparent.com 2022 Tickled Media Pte Ltd. All rights reserved
About Us|Team|Privacy Policy|Terms of Use |Sitemap HTML

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it