Adekunle Gold dey celebrate im wife Simi for dia first wedding anniversary togeda. E go for social media write some kain sweet word give her.

Adekunle Write Beta Lyrics For Dis Wedding Anniversary Give Simi For Instagram

Di music star write for im Instagram for Monday, January 13, 2020; where e first share one veri fine foto of im wife and him. He come caption di foto with beta accolade wey e shower give im wife, Simi. He tok say:
“1 year don waka and I no fit tok as God take bless me say na you I dey folow do dis love sontin. You dey make me laff, hard, you fine too much. I get luck say na me go love you forever. We go get plenty more fine fine memories dem togeda. We go do big big tin and we go live awa life for awasef. Love you forever babe.”
View this post on Instagram
Simi sef folow go for Instagram go write her own. She sef celebrate her husband well well with beta lyrics dem. She say:

“Fine fine baby. Di main tin wey you mean to me, I no sure say you go ever rili undastand. I no dey like to share our special time dem, becos na we get am. So people fit no ever even know as you take special reach to me. Na veri veri high level wey be say e high pass oda level dem. nobody connect with me pass you….”
View this post on Instagram
Pretty baby. The very thing that you mean to me, I doubt you'll ever fully understand. I don't like to share our best moments, because they belong to us – so people might never even know the level of your special. It's a really high level that is higher than other levels. No one is more in sync with me than you. I love how you're mindful of me. Nothing's perfect. Not even with your Ikotun background 🤦🏾♀️ – but I love how you deliberately want to be better. You will see something inside film and ask me at 2am how you can be a better man for me. Lol. So cute a man. Before we said I do, 95% of the advice I got was "Endure". I was stumped cos I've never been able to relate. Endure? Forever and ever? Like till the end of your days? Lol. Quite rubbish. Thank you for never ever being someone I've ever had to endure. Don't like it much when people "couplegoals" us – cos as far as I'm concerned, we, i.e me and you, are on a personal journey. Our ups our downs (Olorun o ni je ka rogun down), our growth, our learning and unlearning, our Love (aww) is our story. Everyone’s standard should be their best self. Thank you for being someone that makes me want to be my best self. Moruf, thank you for Year One. They said it’s normally hard. Again, I can’t relate because I loved it. I love you. I pray year two is even better by God’s infinite mercy and grace and love. I thank God for standing with us and giving us sense. And I thank you for being a man that makes loving you worth it. My beautiful dreamboat. My fellow feminist boyfriend. My husband. Ife mi. Onitemi. The love of my life. I will continue to eat your work in the eye of carton. 🥂 to all the forevers we will spend together. PS: Year two is one or two sentences. I have what I'm doing❤️. . PPS: Everyone, please whatever chance you get today, say a prayer for us. I love those 💙
A post shared by
Simi (@symplysimi) on
Singer Omawumi and hubby follow celebrate 2nd wedding anniversary
Na so Omawunmi and her husband sef celebrate their second wedding anniversary for di same January 13. Di singer go Instagram go celebrate her husband. She tok say: “Happy Tradiversary Fine Boy @d_seventeenth … You dey make di tin be like breeze, I go always love you ”

Make we tok true, love na very beautiful somtin and e sweet no be small. Na somtin wey plenty pipo dey pray say dem go find with beta person. Even as our celebrity dey quick comot for their marriage, we dey happy to see say some dey carry go. E dey give hope to their fans. Her husband sef wish her for im own Instagram.
Omawunmi and Mr Yusuf get 2 cute pikin sake of say dem don dey together before dem gree say dem go marry.
Some Ideas To Take Celebrate Your Spouse For Una Anniversary
- Recreate una wedding night menu.
Wetin be di first food wey una chop as husband and wife? Make una chop di food togeda again. Una fit even go market buy di ingredients, come prepare di food togeda. If na food wey una dey chop for house well well you fit add efizi put make e for sweet well well. Dis one na anoda memory wey una no go quick forget.
2. Make una do fotoshoot
Make list of all di special place wey una don go togeda. Den make una go dia go take foto. E fit be where una kiss for di first time. Or di place wey una marry. No call fotografa o! Na una go do foto by unasef.
3. Make Anniversary Music Playlist
Make playlist of all di song wey dey special to una relationship. Then make una go somewhere go relax enjoy di music. Or una fit stay for house and dance!
Huffpost Legit NG
Read dis tori join: Wetin Be Di Stages Of Grief Afta Pesin Pikin Die? This Mama Lose Her 3 Pikin Inside New Year Crash For Canada