Africaparent Logo
Africaparent Logo
EnglishSwahili
  • COVID-19
  • Becoming a Mama
  • Ages & Stages
  • Parenting
  • Health
  • Feeding & Nutrition

Ghana Don Enta Number 2 Among Kontri Wey Get Plenti Women Entrepreneurs

3 min read
Ghana Don Enta Number 2 Among Kontri Wey Get Plenti Women EntrepreneursGhana Don Enta Number 2 Among Kontri Wey Get Plenti Women Entrepreneurs

Di Mastercard Index Of Women Entrepreneurs don tell us di best places for dis world to be woman entrepreneur.

Ghana don cari second for di world ranking wey Mastercard do. Di ranking na to sabi which kontri get women entrepreneurs pass for dis world. Dem dey call am Mastercard Index of Women Entrepreneurs (MIWE).

women

Na evri year Di Mastercard Index of Women Entrepreneurs (MIWE) dey give us informate about di progress of woman dem wey dey do bizness. Dis year, dem come see say 4 out of evri 10 business owner for Ghana be woman. And naim be di highest for di world after Uganda.

Di Sub-Saharan contri wey cari top 10 for di world woman bizness ownership be:

  • Uganda (rank 1)
  • Botswana (rank 3)
  • Malawi (rank 7)
  • Angola (rank 9)

About Di Women Entrepreneurs Report Wey Ghana Cari Second

women entrepreneurs

Na 58 kontri wey di report assess for di world. Plenty challenges dey, wey woman dey face. But na still woman dem dey open successful business pass anybodi. Some of di challenge wey woman biznes dey face for sub-Saharan Africa be:

  • low internet connection
  • dem no dey see technology
  • dem no see money for capital
  • culture and social wahala wey dey disturb woman

But all dis challenge no stop African woman o, she dey hustle dey go. She dey start her own bizness with determination. And na di same thing with di men of Africa. Dem dey folow dey hustle.

Di report tok say e dey show as women fit contribute to economics and society if di challenges dem no dey again ; and if di systems for society done good.

Push factors

women entrepreneurs

Dem Mastercard notice say for Ghana and di oda sub-Saharan kontri dem, na condition dey make di women entrepreneurs start business. Especially for Ghana, Botswana, Russia, Malawi, Angola and Brazil. For dis kontri dem, na 4 out of 10 entrepreneurs start biznes becos of condition.

Di report tok say Ghana woman dem dey progress well well, especially for di area of labour force. Dem get 89 percent participation. And dem dey do pass man for biznes. Dem come still get rank for bizness leadership.

Na becos dem dey do well for all dis areas so, na im make dem kari second position for di world for woman wey dey do biznes. Di report praise dem well well sake of say dem dey do all dis busines even as tins no dey go well for dia contri.

Ghana Don Enta Number 2 Among Kontri Wey Get Plenti Women Entrepreneurs

Dem compare Ghana to oda kontri like Malawi, Uganda, and Angola. Wey e be say Ghana women dem get bank account pass dem. Becos dem dey do biznes pass dem. For example, nearly 40 percent of woman for Ghana get account for bank compared to only 20% for Angola, Malawi, and Nigeria.

Now wey you know say Ghana dey support women entrepreneurs, you fit pack go dia if you like biznes.

CNBC

Read dis tori join: Research: Wetin Be The Correct Way For Take Space Your Pikin Dem

Got a parenting concern? Read articles or ask away and get instant answers on our app. Download theAsianparent Community on iOS or Android now!

img
Written by

AyeeSha

  • Home
  • /
  • News
  • /
  • Ghana Don Enta Number 2 Among Kontri Wey Get Plenti Women Entrepreneurs
Share:
  • Meet the inspiring South African women making a change in their country

    Meet the inspiring South African women making a change in their country

  • Zim woman among World’s Top 10 Most Inspiring Women

    Zim woman among World’s Top 10 Most Inspiring Women

  • The 'Brave Ones': Zimbabwe's Women-Only Rangers Fighting Poaching

    The 'Brave Ones': Zimbabwe's Women-Only Rangers Fighting Poaching

  • This Twitter User Believes Women Cheat Better Than Men

    This Twitter User Believes Women Cheat Better Than Men

  • Meet the inspiring South African women making a change in their country

    Meet the inspiring South African women making a change in their country

  • Zim woman among World’s Top 10 Most Inspiring Women

    Zim woman among World’s Top 10 Most Inspiring Women

  • The 'Brave Ones': Zimbabwe's Women-Only Rangers Fighting Poaching

    The 'Brave Ones': Zimbabwe's Women-Only Rangers Fighting Poaching

  • This Twitter User Believes Women Cheat Better Than Men

    This Twitter User Believes Women Cheat Better Than Men

Get advice on your pregnancy and growing baby. Sign up for our newsletter
  • Becoming a Mama
    • Pregnancy
    • Delivery
    • Losing a Baby
  • Ages & Stages
    • Baby
    • Toddler
    • Kids
  • Parenting
    • News
    • Relationship & Sex
    • Parent's Guide
  • Health
    • Allergies & Conditions
    • Vaccinations
    • Diseases-Injuries
  • Feeding & Nutrition
    • Breastfeeding & Formula
    • Latching & Concerns
    • Weaning
  • More
    • TAP Community
    • Advertise With Us
    • Contact Us
    • Become a Contributor


  • Singapore flag Singapore
  • Thailand flag Thailand
  • Indonesia flag Indonesia
  • Philippines flag Philippines
  • Malaysia flag Malaysia
  • Sri-Lanka flag Sri Lanka
  • India flag India
  • Vietnam flag Vietnam
  • Australia flag Australia
  • Japan flag Japan
  • Nigeria flag Nigeria
  • Kenya flag Kenya
© Copyright Africaparent.com 2023 Tickled Media Pte Ltd. All rights reserved
About Us|Team|Privacy Policy|Terms of Use |Sitemap HTML

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it

We use cookies to ensure you get the best experience. Learn MoreOk, Got it